Wia dis foto come from, Getty Images
Former US President Jimmy Carter don die at di age of 100, di centre e found don confam.
Di former peanut farmer bin live longer dan any president in US history and celebrate im 100th birthday for October.
Di Carter Center, wey dey advocate for democracy and human rights around di world, say e die on Sunday afternoon for im house for Plains, Georgia.
Afta di Watergate, Jimmy Carter sweep to power and promise say im no go lie to di American pipo.
Di peanut farmer from Georgia bin pardon Vietnam draft evaders and become di first US leader to take climate change seriously.
On di international stage, im bin help to broker a historic peace agreement between Egypt and Israel, but e struggle to deal wit di Iran hostage crisis and di Soviet invasion of Afghanistan.
And as a result of warming relations during di 1970s, Carter bin announce for 1979 say Washington go establish formal diplomatic relations wit Beijing.
Dis mean say di US gatz break ties wit Taiwan and close dia Taipei embassy.
After a single term for office, Ronald Reagan sweep am aside, as Carter win just six states for 1980.
White House, Carter become tireless worker for peace, di environment and human rights, and dis na why dem recognise am wit a Nobel Peace prize.
For 77 years, im wife Rosalynn support am, until she die for November 2023. In tribute, e say she be “my equal partner in evritin I ever accomplish”.
Di longest-lived president for US history, e don dey treated for cancer and don enta hospice care for im modest home for Georgia.
Basketball and Baptist faith
Dem born James Earl Carter Jr was on 1 October 1924 for di small town of Plains, Georgia, and na di eldest of four children.
Im segregationist papa bin start di family peanut business, and im mama, Lillian, na registered nurse.
Wia dis foto come from, Getty Images
Carter na star basketball player for high school. Im experience of di Great Depression and staunch Baptist faith support political philosophy.
Im bin spend seven years for di US Navy – and na dis time e marry Rosalynn, a friend of im sister – and become a submarine officer. But on di death of im papa for 1953, e return to run di ailing family farm.
Di first year crop fail through drought, but Carter bin turn di business round and make imsef wealthy in di process.
E bin enta politics on di ground floor, dem elect am to a series of local school and library boards, bifor im run for di Georgia Senate.
Civil rights campaigner
American politics bin dey ginger afta di Supreme Court decision to desegregate schools.
Bicos say im be famer from southern state, pipo bin expect Carter say e go oppose reform but im no follow im papa footsteps for dis mata.
For di two terms wey im hold for di state senate, e dodge kasala wit segregationists including di one wey come from di Democratic party.
But wen e bicom govnor of Gerogia for 1970, na im e bicom more public about im support of civil rights.