Tehran at sunrise on Saturday morning, following Israeli strikes for sites around di Iranian capital

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Early morning for Tehran on Saturday, following Israeli strikes on sites around di Iranian capital
  • Author, Ido Vock
  • Role, BBC News

Israel say dem conduct air strikes against Iran, and dia military say dem hit sites for several areas of di kontri early on Saturday.

Di Israel Defense Forces (IDF) say Israeli aircraft strike military facilities including air defence batteries and missile manufacturing facilities wey dem dey use to produce weapons.

Dem add say di strikes go provide di IDF “broader freedom of aerial action” in future.

Two Iranian soldiers die sake of di strikes, na wetin di semi-official Tasnim news agency report.

Dem bin don dey expect di Israeli retaliation for di Iranian barrage of almost 200 ballistic missiles wey dem bin fire towards Israeli on 1 October for weeks.

At di time, Tehran say di attack na retaliation for di killing of Hamas political leader on Iranian soil in July.

Dem bin fire many missiles wey Israel and dia allies bin shoot down but a small number bin strike central and southern Israel.

Di Israeli military claim credit for Saturday operation shortly afta report of explosions for Iran.

IDF tok-tok pesin, Rear Adm Daniel Hagari say di military don “fulfill dia mission” and demonstrate say dem prepared well-well “to defend di state of Israel”.

Iranian authorities say sites for Tehran, Khuzestan and Ilam provinces bin dey under attack.

Di military claim say dem successfully counter di attacks, even though “limited damage” happun for some locations.

One US defence official tell di BBC say di dem bin inform di US about di Israel strikes beforehand, and say Washington no get any hand inside.

US officials also say di attacks no include Iranian oil infrastructure or nuclear facilities – targets of di Biden administration bin don beg Israel make dem no hit dis facilities.

Di official say di US bin “work with di Israelis over recent weeks to encourage Israel to conduct a response wey dem bin target and proportional with low risk of civilian harm”.

“E be like say na wetin happun dis evening,” dem tok, dem add say make Iran no respond if not “consequences go dey”.

UK Prime Minister Keir Starmer say Israel get di right to defend diasef against “Iranian aggression”. Im echo di call for Iran to avoid retaliation and say di UK go work to “deescalate di situation across di region”.

Tehran say dem attack Israel in retaliation for wetin dem call di “violation of Iran sovereignty and di martyrdom” of Hamas political leader Ismail Haniyeh, wey one explosion bin kill for Tehran in July and Iranian officials blame Israel.

At di time, Iran say di attack na also in response to di Israeli air strike for di southern suburbs of Beirut we kill Hezbollah leader Hassan Nasrallah and Brig-Gen Abbas Nilforoushan, wey be high-ranking Iranian official.

Di extent of di attacks and di precise targets still neva clear on Saturday morning.

Iran aviation authority bin briefly suspend flights but announce say dem fit restart from 09:00 local time (06:30 BST).

Israeli air strikes also target sites for central and southern Syria, Syrian state media report.

Wetin we call dis Video, Watch: Israeli military announce strikes on Iran