Summary
- Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House
- Of di seven key swing states, Trump win North Carolina, Georgia, Pennsylvania and Wisconsin, and dey ahead for Michigan, Nevada, and Arizona
- Kamala Harris never concede yet or address supporters – unhappy crowds comot her watch party before di final result come in
- Republicans don also take di Senate back from Democrats after dem flip some seats
- World leaders don congratulate Trump
- Nigeria President Bola Tinubu congratulate Donald Trump
Live Coverage
Helen Oyibo, Adebola Ajayi, Kareemot Salami, Victor Ezeama and Fiona Equere
-
Una bye-bye!
Na here we go march break on our live coverage of di US 2024 election.
Una do well say una join us.
You fit scroll down to catch up on tori of how dem announce di result.
And to read up on how di election go on Tuesday, click here.
But for now, from all of us from di team, una bye-bye!
-
Six historic firsts for dis election
Di election result today na one for di history books, but e get few historic firsts wey worth mentioning:
- Donald Trump go be di first US president wit criminal conviction to win America presidential election
- At 78, di president-elect na di oldest man to ever dey elected to di position
- Im vice-president, 40-year-old JD Vance, go be di first millennial to take up di role
- Vance wife, Usha Vance, reports say go become di first second lady wit Indian heritage – she be child of Indian immigrants and dem born and raise her for San Diego, California
- Sarah McBride don become di first transgender pesin to dey elected to di US Congress, e defeat Republican candidate John Whalen III and win Delaware seat
- For di first time, di Senate go see two black women dey serve simultaneously – Democrats Angela Alsobrooks and Lisa Blunt Rochester for Maryland and Delaware respectively.
-
Recap of di historic election night – and Trump victory
In case you miss am, dis na a quick recap of wetin don happun for di last few hours:
- Donald Trump don dey re-elected to di White House,e defeat Kamala Harris afta wins for some number of key swing states – including Pennsylvania, Wisconsin, North Carolina and Georgia
- Many world leaders don congratulate am on im historic win – including those from Europe, Asia and Africa
- Harris never officially concede yet – we dey expect to hear from her later
- Na a strong night for Republicans across board, and dem don also take control of di Senate
-
Bitcoin rise to a record high of $75,000
Bitcoin don hit a new record high afta Donald Trump victory, as traders bet say e go come good on im pre-election promises to boost cryptocurrency.
Bitcoin – wey dey volatile – reach just ova $75,000 (£58,000) on Wednesday morning, bifor e fall back slightly.
As wit many policy areas, Trump view on crypto don undergo significant changes ova di years. Once e don call am scam – but more recently e say e go help di US become di Bitcoin “capital of di world”, and e don even launch im own cryptocurrency platform.
Attention go dey focus upon di Securities and Exchange Commission, wey some perceive go dey hostile to cryptocurrencies.
Trump don previously promise to remove Gary Gensler, di SEC chair, “on day one” if dem elect am – one move wey go make crypto enthusiasts happy, and push Bitcoin price higher still.
Stock markets dey rally with investors wey dey relieved at di earlier-dan-expected conclusion of di US election, as well as di idea of a unified US government.
Di US dollar and borrowing rates for US government debt don also rise with investors expecting extra US borrowing to fund potentially massive tax cuts.
Investors also expect di US central bank di Federal Reserve to slow di pace of interest rate cuts, meaning investors better returns on dollar-based assets.
Na wetin don become known as di “Trump trade” – a reaction to di expected impact of massive tax cuts, borrowing and rising inflation.
-
Harris go tok later
Kamala Harris go deliver speech later for Howard University, her alma matter. She still neva comment on di election results.
Her campaign invite supporters to join Harris and running mate Tim Walz at di event for Washington DC.
Di event go run from 19:00 – 23:00 WAT (13:00 – 17:00 EST) (18:00 – 22:00 GMT)
-
Trump running mate vow to ‘neva stop fighting’ for America
President-elect Donald Trump running mate, JD Vance, don vow to fight for di American pipo, following di Republican victory for Tuesday election.
For one post on X, di 40-year-old Ohio senator write: “THANK YOU! To my beautiful wife for making am possible to do dis. To President Donald J. Trump, for giving me such opportunity to serve our country at dis level.
“And to di American pipo, for dia trust. I no go stop fighting for ALL of you.”
Trump and im vice-presidential nominee Vance go take office on 20 January.
-
Wen Trump go take office?
Dem go swear in Donald Trump into office for di inauguration ceremony on Monday 20 January 2025.
Bifor dat, however, di electoral college come into play. States don give certain number of electoral votes based on dia population. Dem award all of dia electoral college votes to whoever win di most vote in each state.
Dem confam dis afta meetings on 17 December.
Di new US Congress go meet on 6 January to formally count di electoral college votes and confam di new president.
-
Wetin Trump presidency might mean for di world
Trump approach fit dey predictable – more transactional, bilateral, protectionist dan Biden. But im decision-making fit dey more unpredictable – and di world get more conflict dan during im first presidency.
Dis na how im presidency fit mean for different issues.
Ukraine – Trump don promise to push Zelensky to cut deal wit Putin, Dis fit involve di loss of territory. Ukraine fear say e go reduce US military & financial support; e dey depend on how fast e fit happun & wetin Europe fit do – if anytin – to fill di gap. But e no dey clear how much Putin go wan deal. If Russia dey fight, Trump fit no want Ukraine to “lose” on im watch. E also dey less fearful of escalation dan Biden. Some analysts no rule out increase in US support.
Middle East – Trump fit give Netanyahu greater chance ova how Israel conduct war against Hamas, Hezbollah and Iran, even potentially support Israeli attacks on Iranian nuclear facilities. E fit also support wider Middle East deal involving Israel and Saudi Arabia.
China – Trump don threaten to impose big trade tariffs on Chinese goods wey go enta into US. Dis fit trigger trade war damaging di world economy. E fit push Europe to decouple more from China economy. But e go send US forces to defend Taiwan?
Europe – Trump go continue to push Europe to spend more on im defence. E fit impose trade tariffs on European goods coming into di US. Some analysts say dis fit act as catalyst, forcing Europe to unite on defence spending, economic reform and policy towards China.
-
No plans for Putin congratulation as Kremlin reduce expectations
You fit expect di Kremlin to dey pleased say Donald Trump win back di White House.
After all, out on di campaign trail, the Republican candidate bin avoid to criticise Vladimir Putin. Unlike Kamala Harris: she bin call di Russian president “one murderous dictator”.
Trump don also question di scale of US military assistance to Kyiv.
Publicly, though, di Kremlin dey go out of dia way to give di impression say dem no happy about Trump victory.
“I no dey aware of any plans [for President Putin] to congratulate Trump,” Kremlin tok-tok pesin Dmitry Peskov tok. “No forget say [America] na one ‘unfriendly country’ wey directly and indirectly get hand for war against our state.”
To reduce expectations – na di result of how Donald Trump first term turn out. Di Kremlin bin get high hopes say Trump presidency go transform US-Russian relations. E no happun.
Still, sabi pipo say leading Russian political scientists dey look forward to Trump part two.
-
Harris neva accept, but e dey normal
All di major news outlets, including di BBC, don call di US presidential race for Donald Trump.
And last night we hear from Trump imself, but we neva hear from Harris and she neva accept di race.
E dey normal and e don happun in di past.
No be until afternoon afta di election na im we hear from former presidential contender Hillary Clinton wen she lose to Trump for 2016.
Harris go tok to her supporters for Howard University, her alma mater, later today wia she dey expected to accept.
-
Views from Lebanon: ‘Trump and Harris be di same’
Wetin be di views from Lebanon?
Wafa Karameh, one retired public worker, tok say: “Di two [Trump and Harris] be di same but hopefully wit Trump tins go dey better dan wetin don happun during di past four years.”
Meanwhile, Omar Baalbahi, wey be engineer, tok say: “All we dey hope be say e go bring peace to dis part of di world. We dey keep our fingers crossed. E be pesin wey dey walk di tok. We don see di Democrats and we don dey suffer … One need to dey optimistic. We get only hope, right?”
Ahead of di election, e bin get plenti unrest for Lebanon, and indeed across di region, over President Biden Gaza policy. Many pipo say Biden get hand for di killings of more dan 40,000 Palestinians as Israel war against Hamas kontinu dia.
And, many say, di US continue to support Israel wit di weapons and bombs wey dem use for Gaza and now against Hezbollah for Lebanon.
“We really no care. Both [Trump and di Democratic candidate, Kamala Harris] get di same policy,” Sanaa El Banji, one pharmacist, bin tok. “Dem support Israel and dem no care about di war and situation for Lebanon. Dem dey always support di policy of Israel.”
But, she add: “Trump dey more aggressive, more direct, more transparent dan di odas.”
-
Mexican president say di kontri go get ‘good relations’ wit US
Mexico President Claudia Sheinbaum tok say Trump victory “no be cause for concern” for her country.
“We be free, independent, sovereign kontri and we go get good relations wit di United States,” she tell di press.
Last time Trump be president, im promise to build wall on di Mexican border to stop immigrants entering di US. Now e don promise to finish am wen im enta office again.
E also don threaten to put high tariffs on di kontri if dem no stop immigrants from crossing into di US.
-
Trump go slap taxes on goods from all over di world?
Di world dey try to work out how serious Trump go tax di entire globe imports into di US, from friend and foe.
Not just individual kontris, such as China, or sectors, such as washing machines, but everything, from everywia.
During di campaign im threaten tariffs in all directions to achieve all manner of diplomatic aims, from containing China, to protecting di role of di dollar, and preventing illegal immigration.
Tariff na “di most beautiful world in di dictionary”, e tok. Na weapon, source of leverage, e intend to use.
Some jurisdictions, such as di EU, don already prepare list of retaliatory actions against di US, afta fear say dem no take such threats seriously enough from Trump last time.
E point big question for di UK too on wia e suppose position imself if dem get transatlantic trade war. Pick one side, or try to be peacemaker?
-
Dollar and Bitcoin go up as Trump win presidency
Di US dollar don go up as Donald Trump now dey projected to don win di presidency and go re-enter di White House.
Investors dey bet say Trump plan to cut taxes and raise tariffs go push up inflation and reduce di pace of interest rate cuts.
Higher rates for longer time mean say investors go get better returns on savings and investments wey dem hold in dollars.
Bitcoin don also hit one record high, following Trump election promise to make di US di “bitcoin and cryptocurrency capital of di world”.
Di value of Bitcoin bin jump by $6,000 (£4,645) to one all-time high of $75,371.69.
-
Trump take Wisconsin by di smallest of margins
Donald Trump win for Wisconsin na di victory wey push am over di line, ensuring im return to di White House.
Im win for di battleground state na by a mere 1% of di overall vote.
Kamala Harris bin need to do well for di suburban areas around major cities like Milwaukee and Madison. And while voters bin support her in high numbers for dis areas, she no manage to make di gains she need.
Donald Trump standing improve across many of di remaining counties.
Im win na di result of small shifts across di state. Neither candidate change di vote share by more dan 5% for any county.
-
Six key things you need to know
If you just dey join us, or need a recap of di last few hours, dis na wetin you need to know:
- Donald Trump don win a historic second term as president, defeating Kamala Harris
- A projected win for Wisconsin hours ago push di Republican over di 270 electoral vote threshold required to win di presidency – and for di victory speech for Florida e say di American public don give am “unprecedent and powerful mandate”
- Some of di issues Trump campaign hard on na those surrounding di economy – wia e don promise to “end inflation and make America affordable again” – and immigration, wia e say e go complete construction of di US-Mexico border wall wey e promise last time around
- Results still dey come in and we dey wait on projections from three swing states – Nevada, Michigan and Arizona – plus Maine – full breakdown of results dey here
- Another key moment of di night come wen di Senate go to di Republicans, meaning di Democrats go lose dis effective majority of just one in di upper chamber of di US Congress
- We never hear from Harris yet, wey im official watch party for Washington DC bin dey deserted hours before dem call di election in Trump favour
-
US 2024 election results
-
How Americans vote
-
Trump win for Wisconsin
Donald Trump don win for Wisconsin, anoda swing state for di US.
Dis make am 276 electoral college votes wey dey more dan di 270 wey e need to win di overall race.
As a result, Trump now dey projected to win di presidency and go re-enta di White House as America 47th president.
-
Human rights group tell Iran to release woman dem detain after she comot her cloth for univeristy