Wia dis foto come from, Getty Images
As di BRICS summit dey come to an end for Russia, some kontris wey include Nigeria don join as partner kontris.
Na 13 new nations di group accept to join as partner kontris wey go dey di Brics initiative.
BRICS decide not to accept any new kontries as full members of di alliance for 2024.
Di 13 new nations dey work towards becoming full alliance members at a later date.
Brics member kontris
Full Members
Brazil
Russia
India
China
South Africa
UAE
Iran
Egypt
Ethiopia
Official Brics partner countries
Algeria
Belarus
Bolivia
Cuba
Indonesia
Kazakhstan
Malaysia
Nigeria
Thailand
Turkey
Uganda
Uzbekistan
Vietnam
Wetin Brics mean and how dem create di group
For 2021, one economist for di investment bank Goldman Sachs, Jim O’Neil, bin create di acronym “Bric” for Brazil, Russia, India and China.
Dem be large, middle-income kontris wey get fast-growing economies for dat time. Im predict say dem fit become di world leading economies by 2050.
For 2006, di four kontris decide to join togeda as di Bric group. South Africa join for 2010 to make am di Brics group.